Skip to main content

BIAFRA NEWS : Kenya government Nnamdi Kanu, We no get hand for IPOB leader arrest and deportation' - Kenya government

 


Kenya goment don deny tori say dem get hand for di arrest and eventual deportation of di Independent People of Biafra (IPOB) leader Nnamdi Kanu to Nigeria.

Oga Machage say di accuse dey false, wrong and illegal plus anybody wey get evidence of when, where and how e take happun for Kenya make e bring am forward.

Nigeria Justice Minister Abubakar Malami on June 29 bin reveal say di goment don repatriate alias return Kanu to Nigeria. But im no tok from where as im praise di efforts of security agencies.

Di Kenya High Commissioner to Nigeria, Wilfred Machage give di informate about how im goment no get any hand inside di arrest as e follow tori pipo tok for Abuja on Friday.

E add join say different kontris don dey linked to di arrest of di IPOB leader like UK, Rwanda, Czech Republic and many oda kontris but na only Nigerian goment fit tok where dem arrest am and whick kontri dem deport am from.

Di High Commissioner say dem no dey happy wit di accuse wey dem sama dia president.

Kenya no be di only kontri wey don tok say dem no get hand for di arrest and deportation of Nnamdi Kanu, di UK goment don also comot dia hand from di mata.

British High Commission for Nigeria bin reveal say dem no dey behind Nnamdi Kanu re-arrest and extradition.

One UK High Commission tok-tok pesin Dean Hurlock say dem dey aware of reports say di Nigerian goment don detain Kanu.

And dat dem no arrest am from UK for extradition purposes, Hurlock add.

According to Nigeria Minister of Information and Culture, Lai Mohammed, Kanu go still answer for di 11 charges of treason, treasonable felony, terrorism and illegal possession of firearms, among others, wey e bin dey face for court before e try to escape justice 2017 and comot di kontri.

"Security agencies arrest Kanu on di 27th of dis month (Sunday) and as I dey tok to you e dey on im way to court," na so oga Malami bin tok.

Federal High Court for Abuja order make e remain for di custody of di DSS, as dem adjourn di till July 26 and July 27.

Dat na wen Kanu trial go start, according to Justice Binta Nyako wey give di order.

Kanu arrest dey come at a time wey di separatist leader dey ginger more of im followers to breakaway from Nigeria to form Biafra land.

Comments

Popular posts from this blog

Nnamdi Kanu Sends Important Message To IPOB Members From Detention

    The detained leader of the proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), Mazi Nnamdi Kanu, has sent an important message to his followers over the Biafra movement. The embattled separatist according to one of his brothers, Prince Kanu Meme, has asked his disciples to trust and comply with directives from the Directorate of State (DOS). Boasting his belief in the separatist movement’s administrative structure, Kanu said “I’m DOS and DOS is me”.  Naija News understands that the DOS, headed by diaspora-based Chika Edoziem has been contending with authority issues since Kanu’s arrest in Kenya in June 2021. It has been observed that IPOB is in disintegration following Nnamdi Kanu’s rearrest and detention. The present situation of the Biafran movement can be likened to that of sheep without a shepherd. However, Kanu in a conversation with his sib...

BIAFRA NEWS : Justice Nyako Is Partisan, Must Step Down From Nnamdi Kanu’s Case – IPOB

  Justice Nyako Is Partisan, Must Step Down From Nnamdi Kanu’s Case – IPOB  IPOB, which made the demand in a statement issued by its Media and Publicity Secretary, Emma Powerful, condemned what it described as the Nigerian government's political and judicial persecution of Kanu using Justice Nyako.  The Indigenous People of Biafra (IPOB) has asked Justice Binta Nyako of the Federal High Court to step down from the case of its detained leader, Nnamdi Kanu.   Bnbpick.io - Earn Free BNB, Faucet, Multiply BNB game Bnbpick.io https://bnbpick.io Bnbpick.io is an Free BNB faucet that enables users the ability to earn free BNB every hour. You are able solve captchas in order to accrue these litecoins.      IPOB, which made the demand in a statement issued by its Media and Publicity Secretary, Emma Powerful, condemned what it described as the Nigerian government's political and judicial persecution of Kanu using Justice Nyako.  According to Powerfu...

IPOB: The Nigerian Civil War, commonly known as the Biafran War

  THE HISTORY OF BIAFRA AND NIGERIA WAR  Israel, Nigeria and the Biafra civil war    The Nigerian Civil War , commonly known as the Biafran War (6 July 1967 – 15 January 1970), was a war fought between the government of Nigeria and the secessionist state of Biafra. Biafra represented nationalist aspirations of the Igbo people, whose leadership felt they could no longer coexist with the Northern-dominated federal government. The conflict resulted from political, economic, ethnic, cultural and religious tensions which preceded Britain's formal decolonization of Nigeria from 1960 to 1963. Immediate causes of the war in 1966 included a military coup, a counter-coup and persecution of Igbo living in Northern Nigeria. Control over the lucrative oil production in the Niger Delta played a vital strategic role. Within a year, the Federal Government troops surrounded Biafra, capturing coastal oil facilities and the city of Port Harcourt. The blockade imp...