Skip to main content

BIAFRA : Mazi Nnamdi Kanu live broadcast today: Port Harcourt area boys mount road blocks, tension for Oyigbo Rivers State

 


Area boys mount road blocks as police disappear for parts of Port Harcourt, southern Nigeria

Tori be say road users and pipo wey dey live for Mile One, Mile Two Diobu area tell BBC Pidgin say area boys dey ask dem for money before dem fit allow anybody to move about.

One man wey live for di Mile two area tell BBC Pidgin say di jaguda boys dey rob dem and dem no feel safe again.

"Sometimes you go see dem three or four, dem go bracket pesin begin ask am, Senior man find us somtin na. If di pesin say im no get money, dem go begin knack ya pocket, collect anytin dem see, dat one no be broad daylight robbery? We no dey safe as dis boys don enter evri corner. Make Goment come out tell us say di curfew don end or not.

Make dem do sometin, Ike Madu tell BBC.

Anoda pesin, Austin Igwe say im see boys wey collect phones and money from pipo for Emenike area of Mile one, although dem no collect im own phone but pipo dey live in fear.

Last week di state Governor Nyesom Wike declare 24 hour curfew for Emenike, Ikoku, Iloabuchi streets as well as for Mile One and Two areas of Diobu for Port Harcourt afta pipo suspected to be members of Indigenous Peoples of Biafra IPOB cause serious gbege for di area under di guise of EndSars protest.

But tok tok pesin for Rivers Police Command Nnamdi Omoni say dem dey on top di situation e add say "we dey re-strategise to work better."

Pipo for Oyigbo dey run comot for di area for fear say gbege fit happen for di area inspite of di curfew wey dey ground.

Rivers State Governor, Nyesom Wike bin don charge local goment chairmen and youth leaders for di State to fish out members of di proscribed Indigenous People of Biafra IPOB wey dey dia communities, and especially for Oyigbo wia dem bin fly di Biafran flag.

Governor Wike say Rivers State no go ever dey annexed to any state or zone as e dey for Niger Delta and e go remain for Niger Delta.

"We no go allow am. All our vigilante groups dey encourage to dey alert and work wit security agencies to make sure say notin call IPOB exist for dis state. No procession, not even meeting anywia."

Igbos dey live and do business here and dem go continue to live and do dia business here, we support dat one but dat terrorist group call IPOB no fit determine wetin go happen for our State. E no go happen and we no go allow am happen." Im tok

Di Governor say di N50 million naira bounty on top Stanley Mgbere wey dey reported to lead IPOB members to attack di Palace of di King of Onne still dey as di Governor reject di plea for im clemency.

But Stanley Mgbere say im no be member of IPOB as di Governor no get di correct information for di mata.

For video wey im make, Stanley Mgbere say im no be IPOB member but im be full Onne indigene. Im ask di Governor to investigate di matter very well becos na peaceful EndSars protest im follow odas do for Eleme as oda pipo also do di protest for oda parts of di kontri.

But sake of di N50 million bounty wey Governor Wike put for Mgbere head, di leader of IPOB, Nnamdi Kanu bin react to di pronouncement of di Governor for one of im broadcast for Radio Biafra and also promise to give N100 million naira to any pesin wey go kill di Governor.

Di State Goment never respond to dis one.

Comments

Popular posts from this blog

Nnamdi Kanu Sends Important Message To IPOB Members From Detention

    The detained leader of the proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), Mazi Nnamdi Kanu, has sent an important message to his followers over the Biafra movement. The embattled separatist according to one of his brothers, Prince Kanu Meme, has asked his disciples to trust and comply with directives from the Directorate of State (DOS). Boasting his belief in the separatist movement’s administrative structure, Kanu said “I’m DOS and DOS is me”.  Naija News understands that the DOS, headed by diaspora-based Chika Edoziem has been contending with authority issues since Kanu’s arrest in Kenya in June 2021. It has been observed that IPOB is in disintegration following Nnamdi Kanu’s rearrest and detention. The present situation of the Biafran movement can be likened to that of sheep without a shepherd. However, Kanu in a conversation with his sib...

Judge transfers Nnamdi Kanu’s motion to CJ for reassignment

Judge transfers Nnamdi Kanu’s motion to CJ   on   September 15, 2025 By   Matthew Atungwu   Justice   Musa Liman of the Federal High Court in Abuja, on Monday, sent back to the Chief Judge, CJ, a motion filed by Nnamdi Kanu,  leader of the proscribed Indigenous People of Biafra, IPOB, for reassignment.      Make money online with cheelee Kanu, in the motion ex-parte, is seeking an order of the court transferring him to Abuja National Hospital for urgent medical attention. Justice Liman, in a short ruling, made the order transferring the case file back to the CJ, following an application by Kanu’s counsel, Uchenna Njoku, SAN, considering the fact that the annual vacation of the court would be ending The Department of State Services (DSS) lawyer, Chief Adegboyega Awomolo, SAN, did not oppose Uchenna’s application. Earlier, upon resumed hearing in the case, the judge hinted that there was no time anymore for the vacation court to decide Ka...

BIAFRA NEWS : They want me to die outside – Nnamdi Kanu declares he’s suffering from congestive cancer

    https://youtu.be/ydkInTB3qMg?si=xc6uMOY9xngUy1Yt Detained leader of the Indigenous People of Biafra, IPOB, Nnamdi Kanu, has said he’s suffering from congestive cancer. Nnamdi Kanu granted an audience to the media during his appearance at the Abuja Federal High Court, on Tuesday. He said the Department of State Services, in whose custody he has been kept, are not taking his health condition seriously “The Court is entitled to change its mind. They will change their mind. My right must be respected. My right to fair hearing must be respected. “I have congestive heart failure. Basically they want to keep me alive so that when they calculate that I’m about to give up, that my heart is about to pack up, they’ll now say ‘go’. “So that when I go outside, I’ll die outside. That’s what they’re trying to do. The medications they’ve been giving to me have not been working. “They don’t know what they’re doing. They know they don’t know what they’re doing.” The leader of the...