MTN, Glo, Airtel, 9mobile di major mobile phone networks for Nigeria don release easy and quick steps for subscribers to use register dia National Identification Number NIN for dia phone. Dis dey following di order wey Nigerian Communication Commission give for everybody wey dey use SIM cards to validate dia registration by linking dia NIN. NCC give two weeks deadline till 30 December for telecommunication operators to block all customers wey no gree register dia SIM cards wit di National Identification Numbers. You fit check your National Identification Number NIN just by using USSD code on your phone. Di National Identity Management Commission ask Nigerians to use dial *346# to retrieve dia NIN number. Di USSD code dey available for customers wey dey use MTN, Airtel, 9mobile and Glo network. Quick way to get NIN registration form & check NIMC Enrolment centres WIA DIS FOTO COME FROM, NATIONAL IDENTITY MANAGEMENT COMMISSION Wetin we call dis foto, National ID card Wetin you ...
IN GOD WE PUT OUR TRUST